A song made by Mson Samuel
A song made by Mson Samuel
Hmm... Sarah oh
Wetin I do you?
Sarah you carry your love commot
Give am to the man for next door
After all the jollof wey I buy
After all the Uber wey I send
You dey tell me say e don finish
But Sarah, e never finish oh
I still dey here dey wait for you
Your broda wey dey next compound
E go break your heart, you go see
Sarah, Sarah, Sarah my baby
Wetin the neighbor get wey I no get?
Sarah, Sarah, come back to me oh
This love no easy to forget
When you dey cry for night
Remember say I warned you
Sarah oh, Sarah oh
The door still dey open for you
I know say you go miss my touch
How I dey make you laugh too much
That your neighbor, e no sabi you
Like the way wey I sabi you
E no go sing for you like this
E no go patient when you vex
Sarah when e break your heart finish
Make you no shame to come back home
Sarah, Sarah, Sarah my baby
Wetin the neighbor get wey I no get?
Sarah, Sarah, come back to me oh
This love no easy to forget
When you dey cry for night
Remember say I warned you
Sarah oh, Sarah oh
The door still dey open for you
I still dey wait oh
Sarah... my Sarah
Chai...