A song made by Octavia Anayo 💖💗❤️🔥
A song made by Octavia Anayo 💖💗❤️🔥
Leo Tasia...
Ukamaka my Blessing
This na your song oh
From my heart to ur ears, I sing this melody to u
November 19, 2023, for Waru, nah the day wey I tell u say I dey go back to wumba
And I promised u that I go comeback oo comeback for us
But that time I dey fear to tell u that I luv you.
my heart dey always calm down when ever u dey around
Your smile scatter my senses, I no fit form
Leo Tasia you be my queen, no storm
I later comot, I come back, you still dey my mind
Even all the times when I dey wumba, u always dey my mind
Lady Kangaroo, Little Goddess, one of beauty
Memories wey we share, e dey sweet my soul forever forever
Turtle Ninja, you don make my life whole
blessing ukamaka, my soulmate, my mummy, my everything
Sweet Lips wey dey make my heart sing
I go keep you safe, make you the happiest woman on Earth. Baby make u no leave me oo.
Forever with you, Leo Tasia, till the end of time, amen
Leo Tasia, my sweet wife forever, my love so true
Every single day, I dey fall deeper for you like say nah juju
October 15, 2025, which was the day
I ask you to be my woman, and u agree say u go be my girlfriend and my wife
my heart dey beat slow
You say yes, you remember the day wey we do blood test?
How sweet it was that night we share our first kiss, so shy,to make a move e con be like say u dey fear, u focused dey look me inside my eyes
E be like heaven open when that ur sweet lips touched mine I no fit lie.
Hope u haven't forgotten the day me and u enter inside akeke together, how the moment was so sweet because nah only me and u sit-down for back chair
Nobody to distract us, body con dey sweet me that time wey u carry ur head and put for my shoulder aah ahh
All the names I dey call you, na from deep inside my heart
You be my turtle ninja, my soul mate, my missing partner
I promise you, Blessing, I go love you well my sweet Ukamaka "Leo Tasia"
Together we go rise, and shine,our story we go tell oo
Leo Tasia, my soulmate, my mummy, my everything
Sweet Lips wey dey make my heart sing
I go keep you safe, make you the happiest woman
Forever with you, Blessing, till the end of time, amen
Leo Tasia my forever, my love for u is so true
Every single day, I dey fall deeper for you
Blessing Ukamaka
You be my Leo Tasia forever
I love you, mummy
Forever and ever
I no go fit wait to see u Carry my babies inside ur womb oo
The only bby girl wey dey give me everlasting joy
I promise to stay with u forever
Ur Bobo swy always miss u so much
it seems like u have taken the whole of me, bcs am so much addicted to u these days
My number One favorite person
My sweet lips
My sweet curve
U too sweet
My best friend ever
Can't wait to show u wetin e mean to be in luv with someone like u.
Stay with me and everything go surly better with u by my side, I gat nothing to worry about
I luv u so much my super lady.
I luv u so much Leo Tasia, Leo Tasia, Leo Tasia
U go forever be in my heart my baby Gul.