A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
Dis world na Barrack
Dis world na barrack,everybodi wey dey inside na soldier,everyday wey dey inside dey fight hunger,dey fight billings,dey fight witches and wizard,dey fight family wahala,dey fight govament wahala,war no dey finish for dis world.
Soldier kpai,soldier kpai,soldier kpai,soldier rotty, barrack no dey spoil,barrack no dey rotty,barrack na ocean,he no dey dry,he no die.
Life go kpai,soldier kpai go,barrack go still dey gidigba,gidigba,war no go finish,barrack go dey,barrack no dey comot ,barrack no dey rotty.
If you dey fire wahala,fire am wella,kill am wella,burn,mamaram wella,shoot am,chuk am gbagba,shake am ,confirm say he don kpai.
Soldier kpai,soldier kpai,soldier kpai,soldier rotty, barrack no dey spoil,barrack no dey rotty,barrack na ocean,he no dey dry,he no dey kpai.
Barrack be like ocean,he no fit kpai,he no fit dry,no fit roty,he no fit fly,no fit waka,he no fit crawl,he no fit spoil,na soldier wey dey inside dey kpai,dey rotty.
Use your life do beta tins,no do pass yasef,no carry wetin big pass you,fight the war with your akonuche,carry uche follow bodi anywhere wey you dey go.
Soldier kpai,soldier kpai,soldier kpai,soldier rotty, barrack no dey spoil,barrack no dey rotty,barrack na ocean,he no dey dry,he no dey kpai.
Na soldier wey die na him loss pass,na him go see devil,na him go tell devil and him demons how rough and tough life dey.
Pesin wey jump enta river wey no come sabi swim na stone him be,the one wey sabi swim na fish ,the one way stay for bush na tree.
Soldier kpai,soldier kpai,soldier kpai,soldier rotty, barrack no dey spoil,barrack no dey rotty,barrack na ocean,he no dey dry,he no die.
Inside dis barrack,some dey jolly,some dey suffer,some dey cry to baba god everydey,some dey beg pipple for help,some dey work everydey under the sun and rain make life beta.
Who no come no go know,and who know no go come,who sabi fly ,who sabi fly,no fit fly fire,who sabi kiss,who sabi kiss ,no fit kiss tunda.
I dey pray to baba god make dis life soft like today bread,make night sweet like morning akara,make moni no run live us,make life beta for hand wey dey suffer and the head wey dey solve problem wella wella.
Soldier kpai,soldier kpai,soldier kpai,soldier rotty, barrack no dey spoil,barrack no dey rotty,barrack na ocean,he no dey dry,he no dey kpai.
No dulling,no sleeping for dis barrack,we go jolly am,flex am ,run am like limo and bentty,we go pop like champagn,nakam like soft yansh wey dey shake.
Make i see am well na why bullet kill antelop for forest,see finish na why gods reject dockfowl for sacrifice,no put for eyes wetin dem dey put for tongue,you go confirm wetin nobody tell you.
Soldier kpai,soldier kpai,soldier kpai,soldier rotty, barrack no dey spoil,barrack no dey rotty,barrack na ocean,he no dey dry,he no dey kpai.
Who no come no go know,and who know no go come,who sabi fly ,who sabi fly,no fit fly fire,who sabi kiss,who sabi kiss ,no fit kiss tunda.
Inside barrack oga too plenty,G O C dey,armed robber dey,ashawo dey,tiff gan plenty,pastor plenty,Imam dey,Afa dey,afa wey be native dey,native men plenty on coded and uncoded tins...plus.