A song made by Losom G Ent.
A song made by Losom G Ent.
Yeah yeah
Omolosho to Simiat Ajoke
Happy birthday my Adorable woman
Simiat Funmilola, omo you be my everything
The day wey I met you, my heart begin dey sing Ekunoladayomi
Two pikin wey we get, Adil and Arif
You carry dem nine months, you be super mama unshakable madam
Your love dey sweet me like jollof wey don done spicy and colourful
Every morning I wake up, I thank Almighty Allah for gift of you and the production of our kids
You dey my side through wahala and through ginger our story must 2 Dayo
My beautiful wife, you be my forever
Simiat oh, Simiat oh Ekunoladayomi
Happy birthday Happy birthday to you my darling oh
Funmilola Ajoke, you dey shine like star
Omotola dey celebrate you with his family near and far
Simiat oh, Simiat oh Ekunoladayomi Ajoke
My queen, my love, e choke! Well well
Ademola and Ademilola dem dey sing for you
Happy birthday mama, Happy birthday mummy we love you true! Daddy adorable so much Happy birthday mama happy birthday mummy
You know say you be baddest, no competition at all
The way you dey take care of this family, you stand tall for real
Your smile dey light up room like NEPA just bring light
With you by my side, everything dey alright the birthday mama you be our super protector your prayer and charity dey make life easy
Today na your day, make we celebrate am well all the family are singing your name Funmilola Ajoke Ekunoladayomi
Ko si wahala, only blessings I dey hail
More years of joy, more years of love and peace, Prosperity and promotion is already at your door
Omotola and your kids promise you say the ginger no go cease
Simiat oh, Simiat oh Ajoke Ekunoladayomi
Happy birthday happy birthday many happy returns to you my darling oh
Funmilola, you dey shine like star
Omotola dey celebrate you from near and far
Simiat oh, Simiat oh
My queen, my love, e choke!
Ademola and Ademilola dem dey sing for you
Happy birthday mama, we love you true!
Forever my Simiat
Happy birthday my queen
Omolosho dey say I love you die!