A song made by Asiwaju Olalekan Ademeto
A song made by Asiwaju Olalekan Ademeto
E choke! E choke!
Your day don reach oh!
Today na your day, person pikin
Make we celebrate, no be small thing
From January to December, e don reach your time
God don bless you, e dey shine shine
Look how you dey glow, omo see levels
Your age adding, but your blessings dey double
Make we spray you money, make we pop champagne
Your matter different, you no dey play
Happy birthday to you oh!
Make dem bring the cake, bring the jollof too
Happy birthday to you oh!
Today na your day, we go celebrate true true
E choke! Your level too high
Happy birthday oh, make we party till we fly
Anoda year of blessings, anoda year of grace
Look your fine face, chai, see this babe
All your enemies, dem don dey shame
While you dey chop life, dem dey look like mumu
Your mates dey find you, but you don comot
God butter your bread, e add plenty jara
So today we go dance, we go spray, we go shout
Birthday pikin, this your matter no get doubt
Happy birthday to you oh!
Make dem bring the cake, bring the jollof too
Happy birthday to you oh!
Today na your day, we go celebrate true true
E choke! Your level too high
Happy birthday oh, make we party till we fly
Your day don reach!
Wahala for who no celebrate!
Mo gbe!