A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
Dem go fan you,
come waka you join.
Dem no dey see your struggle,but your success dey make dem shake tail like dog wey wan collect from the owner.dem go dey fan you wen dey wan collect,once,source dry,dem go fly comot like bird come do you waka.
Dem go wow you for front,do you waka for back,dem go fan you for front ,come fire you for back.
No go forget one broda wey,i dey always support,he come to my house,we chop,we drink ,yarn like brothers,we come drink from one cup.
Dem go wow you for front,come do you waka for back,dem go fan you for front ,come fire you for back.
Two weeks later,broda go summon me for family council, sey we be broenemies.i no come understand again,pesin wey chop my food,drink my water,collect my help,dey summon me ,sey we be broenemies.
I no fit cry,i no fit shout,i no fit close mouth,i no fit talk,
Life come tire me,wicked pipple dey,but i thank God say my life still dey,my life still get spared.
Dem go wow you for front,do you waka for back,dem go fan you for front ,come fire you for back.
Family enemies worse pass bandits and terrorist.dem go fan you for front,fire you for back.Dem go beg,beg for money,beg for school fees,dem go beg for house rent ,give dem,give dem,dem go still deny you,say you no do anytin for dem.
One auntie go hail you ,the same auntie go talk wetin you you no talk.Rose beta pass Rosy.dem go carry two siblings head jam jam up and down,still dey beg up and down.
Dem go wow you for front,do you waka for back,dem go fan you for front ,come fire you for back.
Baba God deliver us from evil ,wicked family members ,dem go dey monitor your success,dey wait for bad news ,dem go wait tire.some parents do pass devil,dem go support pikin wey get money,dey hate the one wey dey struggle.
I no fit cry,i no fit shout,i no fit close mouth,i no fit talk,
Life come tire me,wicked pipple dey,but i thank God say my life still dey,my life still get spared.
Dem go wow you for front,do you waka for back,dem go fan you for front ,come fire you for back.
Baba God, na beg i dey beg no allow evil wishes of family member prevail over me.bless me make i dey wella,bless my children,open doors of favour for dem ,carry wisdom join am.
Dem go wow you for front,do you waka for back,dem go fan you for front ,come fire you for back.
Evil monitoring spirit no go see me ,bad pipple no go see me,curse no go see me.Anybodi wey go borrow money,power from the devil on behalf of the family,na him and him immediate family bear the consequences,na still dem go pay.
Family no suppose be a place for rivalry and competition,family suppose be a place for love and care,bad pipple dey shall and good pipple still dey shall ,God pass everybody.