A song made by Emmanuel Omons
A song made by Emmanuel Omons
Ese oh, ese baba
I dey hail you oh
Every morning wey I wake up
I dey see your hand for my life
No be my power, no be my might
Na your grace dey carry me go
Wetin I don do wey you love me so?
I no fit talk am, e plenty well well
From my head to my toe
Your blessings full my body
Ese baba, ese Jesus
I dey hail you oh, I dey see grace
Ese baba, ese Jesus
Your mercy dey follow me everyday
I dey see grace, I dey see grace
For every corner, I dey see grace
Ese oh, ese oh
I dey see grace
When wahala wan wound me
Your grace come shield me
When enemy wan shame me
You come lift my head
Na you dey fight my battle
Na you dey open road for me
Wetin man go talk?
I go dey praise you tire
Ese baba, ese Jesus
I dey hail you oh, I dey see grace
Ese baba, ese Jesus
Your mercy dey follow me everyday
I dey see grace, I dey see grace
For every corner, I dey see grace
Ese oh, ese oh
I dey see grace
Hallelujah, I dey sing
Glory to your name
You too good, you too kind
I no fit measure your love
Ese baba, ese oh
I dey see grace oh
Ese, ese, ese oh
I dey hail you