A song made by Dr Firebrand For Jesus
A song made by Dr Firebrand For Jesus
Hallelujah!
God never fails oh!
Joy don come!
For the struggle wey we face
For the hustle, every day
Baba God dey see our pain
E go wipe our tears away
No be by power, no be by might
Na by His grace we go dey alright
The sun go shine after the rain
Naija go smile once again
Joy don come, joy don come
God dey make us happy oh
Joy don come, joy don come
We no go fear again
Hallelujah! We dey celebrate
God don answer, e never late
Joy don come, joy don come
Naija people praise the Lord!
Wetin man no fit do
God go do am for you
E go turn our morning to dancing
Put new song for our mouth
From wahala to blessings
From sorrow to rejoicing
E dey faithful, e dey true
God of Naija, we hail You!
Joy don come, joy don come
God dey make us happy oh
Joy don come, joy don come
We no go fear again
Hallelujah! We dey celebrate
God don answer, e never late
Joy don come, joy don come
Naija people praise the Lord!
Thank You Jesus!
Praise God!
Joy don come for real!