A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
Use your head
If you no comot monkey hand for soup,he go bcome human hand. Na why snake carry poison put for mouth come mount wella make children no come use am tie firewood.
Na friend wey get best friend and bestie na him give rumours wings to fly to many places.
Life be like a pot of water,if you allow people to fetch am anyhow without control,some go fetch finish,some go piss put inside,some go shit inside ,some go steal the pot carry go sale or put am inside there house.
If you no use your head,dem go use am for you,carry the body put for inside prison.na why coconut wear bulletproof.
Jesus wey come this world ,wey dey do good give everybody ,dem still betrayal am,kill am join.na so this life be ,use your head before dem use am sell drugs and kpai good people join.
If you dull,dem go chop you,match you like grasses.rumour wey get best friend and bestie na him dey go far for road ,dey fly for air too.
The person wey dem use him head break coconut,no dey chop the coconut,no allow anybody use you kpai another person,steal,loot,scatter community.
If you no comot monkey hand for soup,he go bcome human hand. Na why snake carry poison put for mouth come mount wella make children no come use am tie firewood.
Life na jeje,life dey easy for the head wey dey wise.pikin wey get head no dey follow bad pikin go thief.
Use your head,make life better for everybody.no be to thief village drum be the problem,na where you go beat am.
This life na market,no throw stones,if you do,na your family member the stone go reach.no go do anyhow for this life.
No drink anyhow,no chop pass your head,no chop,no drink wetin you no know,use your head my bro.
Jesus wey come this world ,wey dey do good give everybody ,dem still betrayal am,kpai am join.na so this life be ,use your head before dem use am sell drugs and kpai good people join.
Na friend wey get best friend na him dey give rumours wings to fly go many places.
Bro to bro,dey your dey,blow who blow you,push who push,no carry wahala jam who no do you anything,use your number six.
If you dey help people,use your head before dem carry you wey carry persin go meet baba for help ,make dem no use you do sacrifice.