A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
Love na scam
Love na scam,i love you,i love you, na your money go cry,guy man dey waka enta love,him no dey fall in love.
Love na for the two innocents and two mumu wey no dey pay bills.
Tiff wan snatch,arm robber wan collect,me and paddi no suppose fall victim.
Baby,i love you,my gas don finish,i want to you cherish,tomorrow na birthday,i love you wit all my heart,my mama dey sick,babe, come over,i no get t p,i never do my hair.
Though,love no dey stingy,love no be member of stingy men association,but love no be mumu wey fall enta maga hand.Love no be mugu fall,guy man chop.
Love supposed be commitment between two adults who share common feelings for each other without terms and conditions.Two adults who share mutual respect in giving and taking.
Love no supposed be something wey dey between tiff and armed robber.wey there eyes dey shine like halogen light.wetin dey there mind na snatch it,grab it,and run away.
Love no be for mugu and maga,love na something wey dey give beta vibes and vibrations inside the mind.
Wey be say anytime you see lovee ,lover your bodi go dey totori you,your mind go dey do tingili tingili.
My paddi no go fall in love for the place wey you suppose collect and waka.Angela na general services no go pay for the sins of other tiffs and armed robbers.
Tiff wan snatch,arm robber wan collect,me and paddi no suppose fall victim.
Na mugu wey fall in love na him dem go march,collect am wetin no nice,chop am yaga yaga like monkey wey see banana.
Love too sweet ,i no wan kpai like ant,love too sweet i no wan kpai inside pammy like a bee.
Baba God help me and my paddi may we no go carry general service as a wife and mother of our children.Na Emeka wey tear the nylon,chop am yaga yaga yaga supposed pay for him sins,no be me and my paddi dem.
Tiff wan snatch,arm robber wan collect,me and paddi no suppose fall victim.
Love too sweet ,i no wan kpai like ant,love too sweet i no wan kpai inside pammy like a bee.
Love no suppose hard like Olumo rock,love suppose be like today bread,dey shine like fresh akara,
tiff suppose dey run,armed robber suppose dey hide,no be to fall in love.
Love dey sweet wella wen you fall in love wit correct pesin,love soft wen two correct pipple see bright future together.
Love too sweet ,i no wan kpai like ant,love too sweet i no wan kpai inside pammy like a bee.
Na wetin dey sweet pesin ,na him dey kill am ,na wetin you know ,na him go know you,wetin you sabi ,go sabi you,anyways,wetin pesin no know fit still know am come kpai am join.
Tiff wan snatch,arm robber wan collect,me and paddi no suppose fall victim.