A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
Money wahala
Money is good,money na correct paddi,if you get am ,your mind go gallant wella,na so everybody go be your paddi,babes go dey hustle you everywhere.
Money sweet,plenty money come sweet pass ,poverty na pepper body ,baba God ,give us wisdom,carry plenty money join am,open ways where others no see opportunity,carry opportunity gives as jara.
You go dey chill inside beta Bentley and limo,umu asa go dey plenty,bottle of drinks go dey pop and everybody go jolly dey hala your name
Life wey no see money,don suffer tire,life wey sapa don dry go cry tire,money na spiderman,na so you be saviour to plenty people.
Money dey cure poverty,money dey open brain,you go sabi things wella,business opportunities go dey fine you,politicians go dey find you,dey beg you for support.
Every church service na you go dey front seat,dem go make you knight and patron,wey sabi god wella.
Community go give you chieftaincy title,plenty people go dey hail you ,dem go dey celebrate you,
Na so life be my people.
Anyday wey money finish,everybody go fly away like bird,na only you go suffer,na only you go see wiii...
Hunger go wire you like thief wey dem catch for area,sapa go run you street,all the people wey dey hail you ,go dey laugh you.
When money dey your hand ,no buga,no fine wahala put for your head.
Use your head,invest wella,
Make tommorow beta.support madam,invest onto children life.
Money is good,money na correct paddi,if you get am ,your mind go gallant wella,na so everybody go be your paddi,babes go dey hustle you everywhere.
Community go give you chieftaincy titles,plenty people go dey hail you ,dem go dey celebrate you,
Na so life be my people.
Anyday wey money finish,everybody go fly away like bird,na only you go suffer,na only go see wiii...
Money is good,money na correct paddi,if you get am ,your mind go gallant wella,na so everybody go be paddi,babes go dey hustle you everywhere.
When money dey your hand ,no buga,no fine wahala put for your head.
Use your head,invest wella,
Make tommorow beta.support your wife and children,money sabi fly like birds.
Money sweet,plenty money come sweet pass ,poverty na pepper body ,baba God ,give us wisdom,carry plenty money join am,open ways where others no see opportunity,carry opportunity gives as jara.