A song made by Iam Saintkrizy
A song made by Iam Saintkrizy
Hmm... Chukwu...
This pain e dey heavy oh
I lost my papa when I still dey small
E no even teach me how man suppose to dey tall
My brodas dem go, my uncles follow
Now na only me, this pain I dey swallow
Sometimes I dey cry for inside my room
I dey ask why, why this be my doom
But I know say dem dey watch me from above
Still I miss their laughter, I miss their love
Even though the tears dey fall like rain
Even though this heart full of pain
I go stand, I go rise again
For my people wey don go, I go carry their name
Omo I don suffer, I don feel the flame
But their spirit dey guide me through the shame
I go stand, I go rise again
Still standing strong, standing strong
Depression wan hold me, e wan drag me down
Sometimes I no fit even leave my compound
But I remember wetin my papa talk
Say "my pikin, for this life you go walk"
Na their memory dey give me reason to fight
Even when the darkness cover my light
I know say one day, this pain go fade
And I go smile again for the life wey dem made
Even though the tears dey fall like rain
Even though this heart full of pain
I go stand, I go rise again
For my people wey don go, I go carry their name
Omo I don suffer, I don feel the flame
But their spirit dey guide me through the shame
I go stand, I go rise again
Still standing strong, standing strong
To everyone wey don lose somebody
You no dey alone, I dey feel your body
We go stand... we go rise again
Chukwu dey...