A song made by Ernesy❤️
A song made by Ernesy❤️
Intro
Eh eh, you never even do am oh
The one wey I send, you no do am
Verse 1
I send you message, you dey ghost me
Waiting for reply, e don cost me
Said you was busy, I believed you
But you scrolling TikTok, you deceive me
The one thing I ask, na small small thing
You get time for everybody, but me you no bring
I send you the link, you say you go try
But till today, you no even reply
Chorus
You never even do the one I sent to you
You never even do am, what I tell you
I give you all the chances, still you disappoint
Brother, na wetin be the issue? Make you explain am point
Verse 2
Your phone get battery when your girl text you
But for my message, suddenly die the network
E choke! This one na level of wahala
You promise say you go, but you just scatter
I no ask for much, just one simple task
But keeping your word, na too much to ask
Shey you dey mad? Or you no get sense?
You dey play games with my confidence, abi?
Chorus
You never even do the one I sent to you
You never even do am, what I tell you
I give you all the chances, still you disappoint
Brother, na wetin be the issue? Make you explain am point
Outro
You never even do am oh
Ye-e-e-h, you never even do am
See this one!