A song made by Opakunle Temilola
A song made by Opakunle Temilola
Chai... e pain me oh
How person go just change like this?
You remember when I dey sick for bed
You dey wipe my sweat, you dey hold my head
You tell me say "I go dey, no fear at all"
Now you dey ghost my call, you don build wall
Wetin I do you sef? Abeg tell me true
The love wey dey before, e don disappear too
You dey treat am like say na joke
But my heart dey break, I dey choke
You don forget, you don forget
All the nights wey you dey by my side
You don forget, you don forget
Now you dey run, you dey hide
I give you my heart but you no send
You dey avoid me like say I be stranger
You don forget... chai, you don forget
I remember your touch when I need am most
Now na your silence dey haunt me like ghost
You dey laugh with your friends like nothing spoil
Meanwhile my love for you still dey boil
I text you "good morning," you no reply
I see you online but you pass me by
Is it joke to you? This thing wey I feel
My pain na real deal, e no dey heal
You don forget, you don forget
All the nights wey you dey by my side
You don forget, you don forget
Now you dey run, you dey hide
I give you my heart but you no send
You dey avoid me like say I be stranger
You don forget... mo gbe, you don forget
One day you go remember
But I no go dey wait forever
Chai...