A song made by Right Okon
A song made by Right Okon
Baba, I dey cry for You
You be the Father wey remain
Mama don leave this world, Papa follow go
Small pikin like me, where I go run go?
The nights so dark, I dey fear alone
But I hear Your voice say "You're not on your own"
Eseun Baba, even when tears dey fall
You be my shelter, You be my all
Chukwu, I know say You dey see my pain
You be the Father wey go forever remain
Baba hold me close, don't let me go
You be the love wey I need to know
Imela, Olorun mi, wipe my tears away
You be my Father today and every day
Halleluyah! You never leave me
Sometimes I wonder why them go so soon
But Your Word tell me say You dey make all things new
You collect broken heart, You dey heal the wound
Ekwueme, faithful God, my morning go come soon
I go trust You Lord, even when e hard
You be the light for my path when the road get dark
Baba hold me close, don't let me go
You be the love wey I need to know
Imela, Olorun mi, wipe my tears away
You be my Father today and every day
Chineke! You're all I need
Baba, na You be my family now
You too much, I go trust You anyhow