A song made by Raphael JNR
A song made by Raphael JNR
Mama... this one for you oh
I swear down
Since Papa comot this world, you carry everything
Morning to night, you dey hustle, no complaining
I see the tears wey you dey hide for bathroom
I see the way you strong pass any lion
You sacrifice your happiness for me and my sibling dem
Mama, I no go let you down, on God!
Mama I promise, one day you go chop life
No more suffer, only bless and good vibes
You go travel the world, rest your body well well
Mama I promise, heaven and earth go tell
Mama I promise, I go make you proud
Everything you don suffer, I go pay back now
I remember when we no get food for house
You smile say "my pikin, God go provide"
Now I dey work hard, dey grind every day
Mama your pain go turn to joy, I swear
The same hands wey wash cloth for people
Go wear designer, go spray money for owambe
Chai! Mama, your story go sweet!
Mama I promise, one day you go chop life
No more suffer, only bless and good vibes
You go travel the world, rest your body well well
Mama I promise, heaven and earth go tell
Mama I promise, I go make you proud
Everything you don suffer, I go pay back now
For my mama
Queen of my life
I swear... you go enjoy oh
On my life!