[male vocals] Baba
God
abeg
I
no
go
forget
de
dey
wey
det
knock
my
door.
Him
com
wit
guns,
knife
and
hammer,
i
com
dey
tell
baba
God
sey,
my
time
to
kpai
neva
rich.
Fear
grip
me,
my
legs
dey
shake,
my
heart
com
dey
brit
fast,
he
com
be
like
sey
my
own
don
finish.
Juju
no
fit
give
extra
life,
doctors
no
spare
life
to
offer,
medicine
no
fit
cure
det,
babalawo
no
fit
save
your
life
from
kpai,
even
babalawo
no
fit
save
himself.
Na
only
baba
God
fit
save
everybodi
life.
But
baba
God
com
show
me
mercy
wey
i
no
deserve,
baba
God
i
no
go
forget
dis
dey
wey
you
show
me
mercy.
If
man
na
God,
i
for
don
kpai,
com
rotten
for
ground
since.
Det
grab
my
neck,
sweeze
am,
choke
am,
press
my
neck,
kick
my
heart,
grab
my
brokus,
kick
me,
hit
me
hammer,
come
shoot
me
for
heart,
na
so
i
fall,
com
faint,
i
think
sey
all
is
over,
i
tink
sey
i
don
kpai.
He
shock
me
sey,
i
still
dey
alive,
i
go
yarn
you
de
truth
sey,
na
baba
God
run
am
for
me.
No
be
man,
no
be
friends,
no
be
my
papa
and
mama,
no
be
brothers
and
sisters.
I
no
sey
he
sweet
to
get
baba
for
my
side.
Juju
no
fit
give
extra
life,
doctors
no
spare
life
to
offer,
medicine
no
fit
cure
det,
babalawo
no
fit
save
your
life
from
kpai,
even
babalawo
no
fit
save
himself.
Na
only
baba
God
fit
save
everybodi
life.
Na
so
sickness
waka
com
my
life,
i
com
dey
run
from
hospital
to
hospital,
clinic
to
clinic,
herbalist
house
to
native
doctor
house.
I
no
see
solution.
Na
so
i
dey
fear
enitime
wey
night
dey
com.
Still,
baba
God
run
am
for
me.
He
com
be
like
sey
na
sickness
go
kpai
me
at
last,
i
no
see
help
eniwhia,
i
tink
sey
all
hope
don
lost,
i
tink
sey
my
life
don
finish,
i
tink
sey
my
enemies
don
win,
i
tink
sey
my
own
don
dey
concluded
in
de
hand
of
det.
But
baba
God
show
up
for
me.
No
go
rely
on
friends,
no
go
depend
on
family,
no
go
hold
paddi
hand,
no
go
call
alaye,
no
go
whistle
your
guys,
no
go
call
family
members.
Go
on
your
knees
and
call
baba
God,
he
go
answer
you.
He
go
fight
for
you
and
protect
you.
Juju
no
fit
give
extra
life,
doctors
no
spare
life
to
offer,
medicine
no
fit
cure
det,
babalawo
no
fit
save
your
life
from
kpai,
even
babalawo
no
fit
save
himself.
Na
only
baba
God
fit
save
everybodi
life.
Baba
God
don
heal
me,
he
don
rescue
me
from
de
cold
hand
of
det,
he
show
me
sey
him
be
God.
He
show
sey
him
be
over
all
God
above
eni
oda
God.
Baba
God
thank
you
wella,
wella,
i
love
you,
my
life
na
your
own
forever.
Wetin
man
no
fit
do,
baba
God
don
run
am
for
me.
i
no
fit
shout,
i
no
fit
scream,
i
feel
like
crying,
rolling
on
the
floor
and
thanking
God
for
his
show
of
love
and
kindness.
Life
dey
sweet
me,
i
no
wan
go
now.
Gift
wey
go
bring
det
to
my
doorstep
no
allow
dem
give
me,
wahala
wey
go
collect
my
life,
baba
God
commot
am
for
me,
sickness
wey
go
collect
my
peace,
no
allow
am
near
me,
jedi
jedi
wey
go
trouble
my
yansh,
baba
God
commot
am
for
me.
Juju
no
fit
give
extra
life,
doctors
no
spare
life
to
offer,
medicine
no
fit
cure
det,
babalawo
no
fit
save
your
life
from
kpai,
even
babalawo
no
fit
save
himself.
Na
only
baba
God
fit
save
everybodi
life.
Baba
God
no
allow
pain
wear
me
cloth,
no
allow
sickness
wear
me
shoes,
baba
God
no
allow
det
kiss
my
life,
baba
God
no
allow
my
enemies
throw
parti
for
my
kpai.
I
no
sey
i
no
dey
perfect,
i
no
sey
i
no
be
righteous
man,
i
no
sey
i
no
be
good
man,
only
tin
wey
i
sabi
do
na
to
love
baba
God
wit
all
my
heart.
no
allow
dis
love
go
grave
go
lie
down.
Baba
God
no
allow
det
knock
my
door
again,
carry
wings
give
to
fly
above
my
enemies,
carri
fire
put
for
my
mouth,
wey
go
consumer
evil
planners
and
schemers.
Na
beg
i
dey
beg
baba
God.
Juju
no
fit
give
extra
life,
doctors
no
spare
life
to
offer,
medicine
no
fit
cure
det,
babalawo
no
fit
save
your
life
from
kpai,
even
babalawo
no
fit
save
himself.
Na
only
baba
God
fit
save
everybodi
life.