A song made by Sadiq Abdullahi
A song made by Sadiq Abdullahi
Wallahi! Maiduguri!
Yeah yeah yeah
Kai!
From Ramat to Bama Road e dey sweet me oh
Family dey welcome me, love dey overflow
Kosai and fura for morning, suya for night
My people dem too plenty, everywhere I sight
Dem say "Sannu sannu" when I dey waka pass
Everybody wan halla, dem no fit let me rest sef
But this na my city, where my heart dey beat
Maiduguri the baddest, no other fit compete
Maiduguri, Maiduguri, my love!
Everybody know me for this town oh
Maiduguri, Maiduguri, my love!
Family and fans dem no dey go oh
Kai! See this one!
Maiduguri na my home!
Binta say she miss me, Fatima dey blow my phone
Hauwa say "when you dey comot?" abeg make I rest small na
But I no fit vex because the love na real
From Monday Market to Shehu's Palace, every corner na feel
My mama dey cook, my papa dey proud
Younger ones dem gather, make we dey shout loud
This na heritage city, where legends dey born
Maiduguri my darling, from night until morn
Maiduguri, Maiduguri, my love!
Everybody know me for this town oh
Maiduguri, Maiduguri, my love!
Family and fans dem no dey go oh
Allahu! E choke!
Maiduguri na my home!
My hometown, my pride
Wallahi, I no fit lie
Maiduguri for life!
Kai!