A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
Fear who no dey fear
My paddi fear pesin wey no get fear for anybody,na dangerous pesin,the pesin wey i carry enter bush for hunting,say my leg resemble antelop own,fear friend wey dey feel for your pocket.
If you sabi tie,another pesin sabi loose,life na jeje,uwa bu nwayo,nwayo nwayo.
Pikin wey dey learn how to climb tree,go get strong mind.No be cho cho cho,na mind dey decide who be man or woman wey be man.If you wan do strong tin for this life,you go get strong mind wey be like stone.
Pikin wey dem carry for back no know say journey far,the pesin wey beta gods help am crack him kernel nut no know wetin others wey no get that kind favour dey face.
If you sabi tie,another pesin sabi loose,life na jeje,uwa bu nwayo,nwayo nwayo.
Life na jeje,onye gbakaria chi ya no so,if you go run overspeed for inside life,my guy na sudden death ooo.Take life easy,the place wey antelop reach,snail go reach am pass.
The day wey your pocket dry,your guy go run,he go call you lazy,he go call you stingy,he call you wicked man.Na the same man wey dem dey tear him pocket vam! vam !vam! Na him Be good guy,na still him be bad guy.
If you sabi tie,another pesin sabi loose,life na jeje,uwa bu nwayo,nwayo nwayo.
The pesin wey owe pesin for ground,dey ground too.as you collect wetin no be your own,na so your eyes go dey shine like security light wey get presence detection system.If you say,pesin no go sleep,how you wan take sleep,when you go spend all time dey watch am make him no sleep.
Dem no dey cover pregnancy with hands.pregnancy na only thing wey you do for secret wey come expose you for open.Everybodi come see your action film wey you be actor,and pesin wey carry the belle na boss.
If you sabi tie,another pesin sabi loose,life na jeje,uwa bu nwayo,nwayo nwayo.
Fight wey dem separate ,na burial wey dem suspend.People wey wan fight no know say fight and death na the same mama born dem,na fight come senior death.Na why dem talk say,beat my pikin for me,no dey reach the pikin mama for belly.My paddi use your head,na carry load wey no be your own.
Na pesin wey dey do well na him be odogwu,the wrong one na him be odiegwu.Egbe na Egbe resemble for spelling but dem no be the meaning.one na gun,the other na bird,one dey kill bird,and the bird dey chop other birds,na so we see am for this life.
If you sabi tie,another pesin sabi loose,life na jeje,uwa bu nwayo,nwayo nwayo.
The day wey dem born one strong man for town,na the same day dey born another strong man for village.anytin wey you know,he get pesin wey know am pass you.If you sabi tie,another pesin sabi loose.
If you sabi tie,another pesin sabi loose,life na jeje,uwa bu nwayo,nwayo nwayo.