A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
Ezigbo Mama
My mama dey go farm everyday,dey work under rain and sun so that we go fit chop ,wear cloth,go school.God bless you mama.
My mama na my mama,weda rich or poor,weda she dey sick or she gallant wella,weda she dey craze for market,na my mama,she dey fight every eke market day,na still my mama.
God bless me wella make i take good care of my mama pass queen eliza,ezigbo chukwu gozie ma'm for me.
This world na mama,everything wey i get na my mama,my life na my mama,wetin be this life without my mama's love and care.i fit dey sick,mama go make herb,cook am well,give me drink,i go well,come strong.
She go carry me for back go hospital if she no under me again,sometime we go fall for road,sometimes we go fall inside bush,life no easy for mama wey no get him pikin papa for by her side.
She fat or slim na my mama,she short or tall na my mama,she fine or ugly na my mama like that,she dey educated or not na my mama,she dey fry akara,na my mama,she sell pepper for market na my mama.
I go carry big money celebrate my mama,i go build big house for my mama,i go carry my mama go the best hospital for this world,i go open big business for my mama,
My mama na my world,i go live inside till kpai.
People wey no get mama,i no dey mock you na,no be me do am,na baba god wey make fish,come bend crayfish for market ,na him still create elephant wey waka dey shake everywhere,but,na him still come create snail and camelion wey waka small,small.Na so god do am for this life.
But,i pity!mama wey born come throw way the pikin for toilet na god go punish you,mama wey born pikin throw am for bush tunda fire you,mama wey born come throw way am for street na snake go bite your yansh,now, you dey suffer dey waka upandown dey beg baba god,any small thing you don shout Jesus,guilt conscience dey torment you every day and night.
Mama take care of your pikin ,make pikin take care of you tommorow,no yarn say pikin done abadone you ,you run follow another man come abadone pikin for neighbours,for old age you come dey cry,dey tell everybody say your pikin done abadone you.
Sweet mama train your pikin for school or handiwork make god bless pikin,make pikin come take good care of you.
Life na jeje,life sweet,life come beta for pikin wey get good step mother,come sweet for the one wey get good mama wey dey respect papa wella wella.
Bad stepmama fly away,bad mama go far away,evil mama no near me,waka waka mama,dey jump from man to man run away from my life.
Sweet mama train your pikin for school or handiwork make god bless pikin,make pikin come take good care of you.
Life na jeje,life sweet,life come beta for pikin wey get good step mother,come sweet for the one wey get mama wey dey respect papa wella wella.