A song made by Esther Adejoh
A song made by Esther Adejoh
Ah! Wahala dey oh!
Gbese don catch me!
E don tey wey I dey owe this money oh
My guy dey call my phone every single day
I dey run, I dey hide, I no fit face am
The guy come my house, I tell am say I travel
His mama call my mama, wahala don burst
I say make I beg my broda, broda say e broke
I run go my sista, sista block my number
Everybody don hear say I get gbese
Na God! Na God go pay am!
Na God! Only God fit settle!
Gbese! The thing don pass me oh!
Na God! Na only God I get!
I don try hustle, money no dey show
I don sell my shoe, still the thing no reach
My landlord sef dey vex say I owe rent
NEPA don cut light, water sef don stop
I tell my guy say abeg give me time
E say time don finish, say make I pay today
I say broda please, e say e no dey hear
The man vex scatter, say thunder fire me!
Na God! Na God go pay am!
Na God! Only God fit settle!
Gbese! The thing don pass me oh!
Na God! Na only God I get!
Mo gbe! I don finish oh!
Na God... na only God!
Amen!