A song made by COMR Peter Billionz
A song made by COMR Peter Billionz
Mama... mama mi oh
I dey miss you die
Every morning wey I wake up, I dey look for you
Your voice for kitchen, the way you dey call my name
Joseph my pikin, you go late for school again
Now silence dey reign, nothing no dey the same
Library and Information, you been so proud of me
Two hundred level now, but you no dey here to see
I fit read plenty book but e no teach me how
To live for this world when you no dey around
Mama mi oh, mama mi
Heaven don carry my heart away
Mama mi oh, mama mi
Every single day I dey pray
Ko si eni to le replace you
Your love e no get substitute
Mama mi oh, rest in perfect peace
Till we go meet again
I still dey keep your wrapper, the one wey smell like you
Your Bible for the table with your favorite psalm
You teach me say make I strong, make I no give up
But mama how I go strong when my own mama don go?
I know say you dey watch me from above
I know say you dey proud of your Joseph
I go make you proud, I go finish well
Carry your name with honor, this one I dey tell
Mama mi oh, mama mi
Heaven don carry my heart away
Mama mi oh, mama mi
Every single day I dey pray
Ko si eni to le replace you
Your love e no get substitute
Mama mi oh, rest in perfect peace
Till we go meet again
Mama... iya mi
Sleep well
I love you forever